D’Tigress head coach Rena Wakama don unveil her 12-player roster for di 2026 FIBA Women’s Basketball World Cup, with Amy Okonkwo named captain. Di team mix experienced players with new talents and e mark Nigeria third appearance for di tournament afta 2006 and 2018 outings.

Ezinne Kalu and Promise Amukamara na di only players wey remain from di 2018 squad wey become di first African team to reach di Women’s World Cup quarter-finals. Di two of dem go become di only Nigerian players wey go play for two editions of di tournament.

D’Tigress arrive Berlin on Wednesday for di event, wey go run from 4 to 13 September. Dem dey Group B alongside Hungary, South Korea and France, dem go open against South Korea on Friday 5 September for Berlin Arena, face Hungary di next day for Max-Schmeling-Halle, and close di group stage against France on Monday 7 September.

Full squad: Promise Amukamara, Jordan Obi, Elizabeth Balogun, Murjanatu Musa, Pallas Kunaiyi, Rita Igbokwe, Victoria Macaulay, Ezinne Kalu, Shay Ijiwoye, Nicole Enabosi, Amy Okonkwo and Grace Efosa.