Tunisia don comot from di 2028 Los Angeles Olympic qualifiers afta dem lose both legs to Senegal, dem go down 1-0 for di first leg before 2-0 home defeat for di return match. As im dey speak for im post-match press conference, Tunisia coach Haykel Gmamdia show say im dey regret di opening match for Rades, wia im side create plenty chances but dem no convert any.

"Plenty regrets, especially as e concern di first leg. I tink you see di situations, di chances. We dominate, any how, di first match. Di most effective team win," Gmamdia tok, as im hail im players' second-half response before im say Senegal go progress. "Congratulations to Senegal, wey deserve to pass dis third round. Congratulations to di coach and to di Lionnes de la Teranga."

Gmamdia also tok about di warm welcome wey im receive for Senegal, wia im spend time with im padi from im childhood for France. Im support Senegal coach Alioune Abitalib Fall rebuilding project, as im insist say di team need time to mature. "For two years time, Senegal go competitive, simply because di girls go gain maturity and experience. But you gatz let di coach work. Na im be di most important tins."