Nigeria President Bola Tinubu don confam say di $100,000 cash reward wey e promise give every member of di women national basketball team, D’Tigress, don pay. For one statement wey e put for im official X account on Thursday, di president say di naira equivalent of di money wey dem promise don already enter di accounts of di players and di officials.
Di reward date back to Nigeria fifth AfroBasket title in a row, wey dem win for Ivory Coast for 2025. Dat time, Tinubu give every member of di squad and backroom staff national honours, houses for Abuja and cash rewards, wit $100,000 give each player and $50,000 give each official.
"Each player don collect di naira equivalent of $100,000, while each official don collect di equivalent of $50,000, to complete dia package of cash rewards, national honours and three-bedroom homes for Abuja," Tinubu tok. "Any promise wey pesin make, pesin must keep am."
D’Tigress captain Amy Okonkwo thank Tinubu and im wife, Remi, for di way dem don dey support di team steady. Tinubu also talk say di same kind cash rewards wey dem promise give di Super Falcons afta dia 2024 Women Africa Cup of Nations victory, dem dey finalize am now.



