President of di Nigeria Basketball Federation, Ahmadu Musa Kida, don join millions of Nigerians for inside di kontri and abroad to mark di kontri 66th Independence Anniversary. E describe di moment as sometin wey worth to celebrate because of wetin di nation don pass through for recent years and e acknowledge di sacrifices of im leaders.

Kida also thank di basketball community, especially di players, officials, fans and stakeholders of di game. E praise President Bola Ahmed Tinubu for wetin e call steadfastness and unflinching commitment to di kontri growth through di Renewed Hope Agenda.

"Plenti reasons dey why we go celebrate our kontri 66th Independence anniversary. As one people, we don truly weather through plenti turbulent storms and of course, we don always comot stronger and better," Kida tok. E urge Nigerians for inside di kontri and for di diaspora to kontinu to work hard and to pray for kontinued unity, peace, stability and development.