Gabon don become first team to qualify for 2027 FIBA AfroCan afta dem beat Republic of Congo 86-58 for Douala, Cameroon. Di Central African side don secure place ahead of di continental championship wey dey scheduled for Rwanda from July 2 to 11, 2027.

Dem join Morocco, Côte d'Ivoire, Democratic Republic of Congo and host Rwanda,wey automatically qualify as semi-finalists for di 2023 edition for Angola. Rwanda finish third that year afta dem defeat DR Congo for bronze-medal match, while Morocco claim title by beat Côte d'Ivoire for final.

As e dey organise by FIBA Africa Regional Office, AfroCan na continental tournament for national teams wey dey hold evri four years and 12 teams dey contest am, with dem split into four groups of three. Qualifying windows go run between October 2026 and June 2027 to determine remaining spots, and di competition go feature 28 games as teams go play between six and seven matches depending on how dem reach semi-finals.