Two weeks afta Women Afrobasket don end, Cameroon national team still dey locked down for Mont-Fébé hotel for Yaoundé, dem dey wait for bonus from di tournament wey dem finish as runners-up behind Senegal. Di final against Teranga Lionesses na di only match wey Cameroon players lose during di competition.

Negotiation for payment don stall. Afro-basket administrator Toko Ekambi, high-level sports director Oumarou Tado and Fécabasket board first propose two million CFA francs for each player. Sports minister Dr Pierre Ismaël Bidoung Mpkatt later raise di offer reach five million CFA francs each, but dem reject both proposal.

Players say dem don receive threat from members of government. Late on Friday, dem tell dem to comot from di hotel on instruction of di sports minister, one request wey player Amina Njonkou say come from Ekambi. Di players pack dia bags but refuse to comot without seeing written notice, so dem still dey di hotel. Fécabasket own Samuel Tendong Nduku tell Le Jour say di federation no get any role to pay di bonus.