Di Basketball Africa League don unveil six newly refurbished basketball courts for Côte d'Ivoire, Nigeria and Senegal, to support NBA Africa promise say dem go build or renovate 1,000 courts for di continent for di next ten years. Di league talk say di facilities go reach thousands of youth and community members every year.
Di first two courts open for Saint-Louis, Senegal on 30 September, with PETROSEN, and for Abidjan on 3 October with Wave Côte d'Ivoire. More launches dey scheduled through December for Joal and Guédiawaye for Senegal, Dakar, and Owerri for Nigeria.
Di Saint-Louis court dey for Université Gaston Berger, wey be UNESCO World Heritage site. For Abidjan Koumassi district, di renovated court for Groupe Scolaire Lac go serve near 3,000 players every week and e go host development programme for 300 girls wey dey 18 years and below, plus Saturday youth league.
Di Guédiawaye facility na di first BAL4HER court for Africa, wey dem dedicate am to push women and girls for basketball, and di Owerri court go be di second one. Each site get better playing ground, seats for spectators and new stanchions, with some locations add light, changing rooms and sanitation.
"Dis newly refurbished courts show our commitment say we dey invest for communities and make di game dey more accessible for young people across Africa," BAL President Amadou Gallo Fall tok.



