Nigeria centre Stephanie Okechukwu make her Texas Tech debut for Thursday, November 5, and become the tallest womanwey don play for Division I NCAA game. The 7-foot-1 player finish with 6 points, 10 rebounds and 3 blocks for 21 minutes as Texas Tech beat University of North Carolina at Charlotte 64-37 for Lubbock, Texas.

Okechukwu score her first points from the free-throw line after dem fully clear am to compete as she dey pursue her degree. She join the programme for January 2026 but no show for no game last season.

Dem extend her eligibility for four full seasons after Texas Tech successfully ask NCAA for waiver, and reverse earlier decision wey give am only two years. Dem list am as sophomore centre for the team 2026-27 roster.