South Sudan na di strongest contenders to qualify for dis year Basketball World Cup, according to di International Basketball Federation ranking wey Nike present. Twelve African teams dey compete for four World Cup tickets for di final window of di FIBA Basketball World Cup African Qualifiers for Alexandria, Egypt.

Di Bright Stars need just one win for Group F to seal Africa place for di World Cup for Indonesia, Japan and di Philippines. Côte d'Ivoire become di first African side to qualify afta dem win Cape Verde 77-69 on Sunday.

South Sudan rise to di top of di continental rankings last year afta dem top Group B for di first round of qualification with perfect record, including win over defending champions Tunisia. Dem go face Senegal on February 24, 2023.

FIBA tok say: "Di team morale and eagerness to make history dey play for dia favour although di Bright Stars know well well say dem need to dey for dia prime to succeed against Senegalese team wey desperately need wins to return to di World Cup for di third straight time."

Egypt na di second most likely to qualify, followed by Angola, Cape Verde, Senegal and Tunisia, while Uganda and Guinea get di least chance.