South Sudan, wey get Kouat Noi from Sydney inside dia squad, don hammer Mali 85-60 on Saturday for dia second win for Group A of di FIBA AfroBasket 2025 Qualifiers. Di result don extend di Bright Stars unbeaten run for African competition to 7-0, since August 2022.
Na South Sudan second-biggest winning margin for all those games, as only di 101-58 victory ova DR Congo for di second round of di 2023 FIBA Basketball World Cup African Qualifiers on 27 August 2022, for Monastir, Tunisia, dey bigger pass dis one.
Atem Kuany Kuany top-score for South Sudan with game-high 17 points. Dhieu Deing add 13 and Junior Madut contribute 12, as Luol Deng side improve to 2-0 for Group A, after dia opening win ova Morocco.
For Mali side, Tamandjan Konate and Fousseyni Drame na di only players wey reach double figures, as dem finish with 15 and 10 points respectively. South Sudan, wey also get Sydney Kings guard Jackson Makoi for dia squad, go face DR Congo next on Monday.



