NBA Africa and Quest Water Global unveil one new basketball court for Cercle Onatra, Kinshasa, on Sept. 29, to mark di start of one multiyear collaboration to build or renovate 55 full-size and 3-on-3 courts across Democratic Republic of Congo by 2030. Di project dey honour Dikembe Mutombo, di late four-time NBA Defensive Player of the Year and Naismith Basketball Hall of Famer wey serve as NBA first global ambassador afta e retire from di league for 2009.
Quest Water Global go serve as di league Official Infrastructure Development Partner for DRC, to support NBA Africa commitment to build or renovate 1,000 courts across di continent for di next ten years. Di Kinshasa court, wia Mutombo start im basketball journey with Basketball Club Onatra, get im iconic No. 55 jersey number for centre court. NBA Africa host one Jr. NBA/Jr. WNBA clinic for 80 local coaches to mark di unveiling.
One second court go dey unveil for Mutombo hometown of Mbuji-Mayi inside di coming weeks. "My hope be say dis court, and many more wey go come, go help to inspire future generations to embrace dis values, pursue education, and discover di opportunities wey di game fit create," Rose Mutombo tok.
NBA Africa CEO Clare Akamanzi say di collaboration go expand access to basketball across one country wey hold special place inside di history of di game because of Mutombo enduring legacy. Mutombo, wey dem select fourth overall for di 1991 NBA Draft, spend 18 years for NBA and dem induct am into di Hall of Fame for 2015.


