MFM Basketball Club start dia Zenith Bank Women’s Basketball Premier League Final 8 campaign wit 69-35 demolition of Bayelsa Blue Whales inside di Indoor Sports Hall of di National Stadium, Surulere. Di former champions control di game from di opening quarter, according to di News Agency of Nigeria.

First Bank Basketball Club also return to winning way, dem edge Victoria Queens 68-57 for one tight contest. For oda side, Sky Queens of Abuja beat Titans Basketball Club 55-36, one game wey light cut am small before dem continue, while Nigeria Customs Basketball Club wrap up di day fixtures wit 55-41 victory over Air Warriors.

But di opening day no too sweet as long delay and repeated light cut-off for di venue scatter di program. One first game wey dem schedule for 10:00 a.m. eventually start around 1:00 p.m., and dat one throw di rest of di schedule comot and frustrate players, coaches and spectators.

First Bank captain Godgift Joseph say di win don lift her team confidence. "E be great game and we don hustle hard together as team to collect di victory. We go take di game one by one and hopefully reach di final and win di championship trophy," she talk. Victoria Queens captain Toluwani Arogundade, wey dey play for dia first Final 8, say her team still get belief despite di loss.