Michael Jordan jersey from hin 'Last Dance' season don sell for $12.3m (£9.3m), wey be record for any Jordan game-worn memorabilia. Di jersey na di one wey Jordan wear for game three of di 1998 NBA Finals, wey be Jordan last season wit di Chicago Bulls.
Jordan help di Bulls win di series 4-2 for hin sixth and final NBA Championship, and dem name am Finals Most Valuable Player for all di six games. Di previous record for Jordan memorabilia na $10.1m (£7.6m) for hin jersey from game one of di 1998 Finals.
Di game three jersey, entrepreneur Rob Gough put am for sale and e sell for Joopiter, wey be Pharrell Williams' digital auction house, wey don give am estimated price of $10-15m (£7.5m-£11.3m). Jordan 1997 Ferrari 550 Maranello also sell for $2.7m (£2m), four times di auction record for dat model.
"Few objects for di history of sport fit greatness komplete like Michael Jordan game three jersey from 1998 NBA Finals," Joopiter tok for di auction posting. Di record price for any game-worn sports memorabilia still be di jersey wey baseball legend Babe Ruth wear during di 1932 World Series, wey sell for $24.1m (£18.2m) for 2024.



