Former NBA star Gilbert Arenas don publicly question Jonathan Kuminga two-year, $12.4 million contract wit Minnesota Timberwolves, say say di deal need close inspection. Kuminga don previously turn down one $75.2 million offer from Golden State Warriors before dem trade am go Atlanta Hawks.

Arenas raise di matter after di NBA find LA Clippers and Kawhi Leonard guilty of salary cap circumvention, one verdict wey don put evri new league signing under fresh look. "Evri year wey you no take di deal wey you originally get, dat money suppose don dey your f______ pocket by now," Arenas tok.

E push am further, urge Kuminga make e check di paper work around di agreement. "Tell dem make dem look evribody writing. Look your contract. Someone must dey collect money somewhere. Check your family members. Someone dey pay you to look di oda way. Because no way f______ way you suppose don dey sign dis kain b_______ deals," Arenas add.

Kuminga don tok publicly say e join Minnesota to be part of winning culture. Sceptics dey point out say Timberwolves never win NBA Championship before, and say to accept such big pay cut for dis stage of im career carry clear risk.