Nigeria women basketball coach Rena Wakama don promise say she go rebuild D’Tigress afta one big defeat to France end dia FIBA World Cup campaign, and she don set di 2028 Los Angeles Olympics as di next major target.

Wakama tok afta di loss to France say her squad no get plenti experience. “When you get new team and I get plenti young players, I tink I get like five or six young players for dis team wey never don dey dis stage before, and some of dem just commot from college,” she tok.

She single out Grace Efosa for praise afta di young pikin score 15 point inside like 20 minute.

Wakama say rebuilding must start with to identify players. “E start, one, with just who we dey put for di jersey, right? Just to make sure say I dey continue to put di best talent wey Nigeria get inside dis jersey,” she tok.

Even though she hail di support of di Nigeria Basketball Federation, Wakama insist say di team must raise dia level of preparation so dem go fit return to di height dem reach for Paris. She add say di way African and Nigerian players dey show face for elite competition now mean say dis na di best time to dey inside women basketball.