Di Basketball Africa League (BAL), with dia partners, don open one renovated basketball court for Gaston Berger University (UGB) for Saint-Louis, Senegal. Di project dey inside one programme dem design to fix community sports facilities and make playing condition better for young pipo.
BAL president Amadou Gallo Fall attend di ceremony and talk say dem choose Saint-Louis because of di historical importance and di role e dey play for Senegal economic and energy transitions. "E make sense say dis inauguration start here, for Saint-Louis, one historic city, world heritage site, but na also one city wey dey di heart of di kontri energy challenges," Fall tok.
Fall stress say di initiative pass just to rebuild sports venue, and argue say di kontri natural resources suppose still create opportunity for young pipo. "Di resources wey we get under ground no be only for cubic metres or barrels. Dem suppose still allow us to create opportunity, especially for dis youth, by giving dem access to safe play areas," e tok.
Now wey BAL don reach im sixth year of running professional basketball championship for Africa, dem plan to extend di same kind partnership to oda kontries for di sub-region. Fall praise UGB leadership say dem dey work with small resources and e predict say future champions go comot from dat university.



